Advertisement

100 Nigerian Pidgin Quotes and Words of Wisdom to Share with Friends

These collections of Nigerian pidgin quotes and words of wisdom that you can share with your friends are pidgin inspirational quotes.

 Best Nigerian Pidgin Quotes and Words of Wisdom to Share with Friends

Everybody dey shout I dey chop money I dey chop money. Na that particular money you dey cook chop? No be something you dey use am buy? You know how it is now, life wey sweet na small, small them dey take enjoy am.

Seriously, Naija get vibes and if you are cool with it, you go enjoy my people well, well. We no dey carry last and that is why we bring you this better wise sayings of my country people wey go give you joy.

Make you no dey look like Uche, pikin wey get respect, na him dey follow elders chop for the same plate. Make you enjoy we Nigerian pidgin quotes wey be better proverbs wey dey give wisdom unlimited.

Best Nigerian Pidgin Quotes and Words of Wisdom to Share with Friends

My people tori don dey for ground and this one na wetin go make you laugh. Make we take style enjoy this wise words of the elders. You know say wetin we elders talk, na experience wey them don take time see. These collections of Naija pidgin proverbs and words of wisdom which you can share with your friends are pidgin inspirational quotes wey go teach you many lessons of life.

[1]. Anything wey old person stand see small pikin fit climb iroko tree him no go see am.

[2]. Na when money no dey pocket na him poor man prayers dey long pass.

[3]. Na cooperation dey make rice swell for pot.

[4]. Food wey no enter mouth no dey stay for belle.

[5]. Who belle dey worry nor dey waka anyhow o.

[6]. Dem say ashawo way be new for area still be virgin.

[7]. Person wey get one eye is owing blindness.

[8]. Person wey get problem no the pray in English.

[9]. Pikin way dem put for back no know as road far.

[10]. Person wey him father send thief, dey use leg break door.

[11]. One tree e no go fit make forest.

[12]. Them no dey enter forest go cut wood wen e bend.

[13]. Na wen man exercise na em he dey loose weight.

[14]. If man no get money for pocket, em go dey loose multiple weight and memory.

[15]. When dog remember wetin he don chop for long he go dey lick mouth.

[16]. Na woman wey never see run dey run hold breast. 

[17]. Na tu much play make dog fork him Mama.

[18]. No matter how beautiful you are as a girl, you will never hear it from your brother.

[19]. Nobi everybody wey drink water like am, some wan just quench taste.

[20]. Coconut know say journey far, na why em carry em own water.

[21]. Not every goodbye dey sad, imagine you hear goodbye class.

[22]. Dem say person wey get one girlfriend get one eye.

[23]. Make you no tell old women wey open her leg to close am because you no know where she take dey breath. 

[24]. Dey keep your towel clean becuase the side wey clean your yash today fit clean your face tomorrow.

[25]. The same hold up wey dey vex driver na him dey give gala seller joy.

[26]. Persin wey get running stomuch no dey select toilet.

[27]. Na ashawo wey no plan well dey sell ogogoro for old age.

[28]. Person wey carry snuff for hand no dey look watch.

[29]. Na only prophet and native doctors dey eat woman's money.

[30]. No matter the weight of elephant e no fit cause earth quake.

[31]. If life show you pepper, my guy make pepper soup from it.

[32]. Make something good out of a bad expereince.

[33]. Lean on me no mean say you go press me die.

[34]. Na who dey dig hole dey see worm.

[35]. Kontri hard kontri hard no be for davido and his fans.

[36]. Person wey dey carry ashawo for night no dey greet anybody wey he see for road.

[37]. Meat wey you dey forbid, you nor dey use teeth divide am.

[38]. Na early them dey catch black goat, you no go fit see am for night.

[39]. Na fly wey stubborn na in dey follow dead bodi enter grave.

[40]. Fish wey big na big hook dem day take catch am.

[41]. Pikin wey say him mama no go sleep him no go sleep.

[42]. When snake bit small pekin when he see worm he go run.

[43]. Na as wound take dey nurse take dey treat am, if you wound anyhow nurse go sew am anyhow.

[44]. Empty drums na him dey make the highest noise.

[45]. If you take cow eye look life, na only grass you go dey see.

[46]. I dey travel I dey travel, na person wey e never reach him turn.

[47]. Dem no dey know t***t*** wen he dey born twins.

[48]. Character dey like pregnancy, eh no dey hide.

[49]. Pikin wey say mama no go sleep herself no go sleep.

[50]. The stone wey dey water no know sun nah.

[51]. Person way buy foul or chicken for market go look him head.

[52]. Pikin wey em mama dey sell charcoal one dey e go wear white but e no go stain.

[53]. Na who know no say dis life na scam go say dis life know balance. 

[54]. Na only the head, na only the head, na him make nkechi carry bele.

[55]. Person wey no wear clothes no dey put hand for pocket.

[56]. Na for village primary school the bell dey sound like music for closing time.

[57]. Old mama were no get teeth again dey chop!

[58]. Na over confidence make February no complete.

[59]. Na wetin dog see dey make am dey bark.

[60]. Live wetin them write for moto enter moto.

[61]. Person wey dey find sugar before he go drink garri hungry never touch am be that.

[62]. No day ask toad for chair because himself day sidon.

[63]. Pesin wey get one cloth no dey follow pesin wer hem papa dey sell butic play for rain o!

[64]. Use your tongue count your teeth!

[65]. Na mouth weh eat pepper, pepper dey wori.

[66]. Person wey e mama dey sell mama-put, no no waitin dem dey call hunger.

[67]. Anything come person chop, exam come person fall.

[67]. Big eye no be open eye.

[68]. If you close eyes make you no see your enemy wen your friend go pass you no go see am.

[69]. Woman wey dey find pikin no dey wear pant sleep.

[70]. Na from wetin person dey sell e dey chop no be for person wey dey sell soap or chemical.

[71]. Person wey him Papa first pay school fees no mean say na him go carry first for class.

[72]. Rain wey beat us today, go wash our moto tomorrow.

[73]. Pikin wey no grow up, no fit wear him Papa cap.

[74]. Eye wey de close na breakup go open am.

[75]. No be all good bye sweet for ear.

[76]. Pikin wey talk say him Papa no build house go soon sabi how e dey go.

[77]. Escort me escort me na so slave trade take start.

[78]. Pikin wey get only one cloth no dey follow others play for rain.

[79]. If one ashawo dey for the area, she dey use yanka dey pepper guys for the area.

[80]. Food wey go run belle dey always sweet for mouth.

[81]. Just the cap, just the cup na so amaka take get belle.


[83]. Pikin wey them carry for back no know say road far.

[84]. Pesin wey piece hold no dey beg for drinking water.

[85]. Pikin wey no get helper supposed to get sense.

[86]. Woman wey de find pikin no de wear pant sleep.

[87]. Nobody hustle harder than person when not get anybody to ask for money.

[88]. Na corporation make rice full pot.

[89]. Na just time e go take, stamerer go call him Papa name.

[90]. No matter how strong you be make you no joke with the woman way dey cook your food because she fit make you see Sani Abacha today.

[91]. Person wey dey live for glass house no dey throw stone anyhow.

[92]. My people no matter how hard the jungle is lion no dey chop grass.

[93]. One day pikin way him Mama dey sell charcoal go wear white cloth and e no go stain.

[94]. Pikin wey im Mama dey sell palm oil no dey wear white cloth.

[95]. If trust dey water for no boil fish.

[96]. Person were like to play with dog na him wey dog go tear him cloth.

[97]. Goat wey get mind follow lion go catch fish, make e get am for mind say weda they catch fish or not lion food don set.

[98]. E better make you late than make you be the late.

[99]. Person wey get serious problem nor dey use English pray.

[100]. Person wey borrow clothes wear go part no dey dance anyhow.

COMMENTS

Advertisement
Advertisement
Advertisement
Advertisement
Name

About,1,Anniversary,11,Birthday,26,Bookshop,6,Condolence,7,Congratulations,19,Contact,1,Disclaimer,1,Love,13,Messages,29,Motivation,18,Music,41,Paragraphs,35,Pets,10,Pidgin,4,Poem,4,Prayer,7,Privacy,1,Quotes,7,Relationship,22,Sitemap,1,Terms,1,Videos,15,
ltr
item
Lovely Messages – Spreading Love, One Message at a Time!: 100 Nigerian Pidgin Quotes and Words of Wisdom to Share with Friends
100 Nigerian Pidgin Quotes and Words of Wisdom to Share with Friends
These collections of Nigerian pidgin quotes and words of wisdom that you can share with your friends are pidgin inspirational quotes.
https://blogger.googleusercontent.com/img/a/AVvXsEjIImWBBfLyuxWZ5gp7Ual8OyQXojDk765CjkPo3i-oAw45XqzbmlgztLncEpf232Y26F4P9pM9NTP_8tMdjaTUywXvXPr7BGf2CI7dyBCgHhnqVOwdPsnk3IGZZ84qRxjQJ0-IIaD2Cz1bxMl9pruQwbcbIb86LhMW-_HiTEdgkrHheyAQU3v8gw=w640-h512
https://blogger.googleusercontent.com/img/a/AVvXsEjIImWBBfLyuxWZ5gp7Ual8OyQXojDk765CjkPo3i-oAw45XqzbmlgztLncEpf232Y26F4P9pM9NTP_8tMdjaTUywXvXPr7BGf2CI7dyBCgHhnqVOwdPsnk3IGZZ84qRxjQJ0-IIaD2Cz1bxMl9pruQwbcbIb86LhMW-_HiTEdgkrHheyAQU3v8gw=s72-w640-c-h512
Lovely Messages – Spreading Love, One Message at a Time!
https://www.lovelymessages.com/2022/01/nigerian-pidgin-quotes-and-words-of-wisdom-to-share-with-friends.html
https://www.lovelymessages.com/
https://www.lovelymessages.com/
https://www.lovelymessages.com/2022/01/nigerian-pidgin-quotes-and-words-of-wisdom-to-share-with-friends.html
true
8615284370024403160
UTF-8
Loaded All Posts Not found any posts VIEW ALL Readmore Reply Cancel reply Delete By Home PAGES POSTS View All RECOMMENDED FOR YOU LABEL ARCHIVE SEARCH ALL POSTS Not found any post match with your request Back Home Sunday Monday Tuesday Wednesday Thursday Friday Saturday Sun Mon Tue Wed Thu Fri Sat January February March April May June July August September October November December Jan Feb Mar Apr May Jun Jul Aug Sep Oct Nov Dec just now 1 minute ago $$1$$ minutes ago 1 hour ago $$1$$ hours ago Yesterday $$1$$ days ago $$1$$ weeks ago more than 5 weeks ago Followers Follow THIS PREMIUM CONTENT IS LOCKED STEP 1: Share to a social network STEP 2: Click the link on your social network Copy All Code Select All Code All codes were copied to your clipboard Can not copy the codes / texts, please press [CTRL]+[C] (or CMD+C with Mac) to copy Table of Content